Posts

Her Family Is Cursed 2 by Angela Nwosu

Her family is a shame; Part 2! My name na Chima. Na me be Precious husband. E worry me say my wife mama wan stay for my house small. The woman wahala too much. The last time wey she come, na so she just dey cause plenty quarrel for where me and my wife dey. She go dey give am bad advise to dey check my phone and monitor me. If I dey make call, she go tell her pikin to go there and tell me to put my call for speaker, make everybody dey hear, so many things wey my wife no dey do before. The day wey I gather liver confront am, she threaten to slap me, na vex I take pursue am comot for my house. Since that day, I never use these my two eyes see her. I wonder how my house go be this small time wey she carry her other pikin come. I dey always first my wife close from work, because na self employed I be, I get plenty people wey dey work for me, so I fit go house anytime wey I like. My wife own be say na bank work, na night she dey use reach house every day. As I enter house, the first person ...

Her Family Is Cursed 1 By Angela Nwosu

This story was told by a woman it happened to. I got her permission to write it on Facebook. Everything I will write in this story is 💯 % reality. The only difference is that I will tell it as a story and use different names for the people involved. ******************** Her family is a shame! My name na Precious, I be 33 years old. My husband name na Chima, he be 40 years. We don marry for 7 years, na this year go make am 8. We get 3 children, 2 girls and 1 boy. Me and my husband dey get the usual husband and wife wahala, but im no dey beat me or make me suspect am. I dey work for bank, while im get im own business and im dey do very well, money dey yakpa.  Na me be first born, I get two brothers and one sister, dem dey live with my mama, my papa don die since 5 years now. After I born my last pikin, my mama get serious problem with my husband when she come omugwo, for my last pikin, over money matter. Since then, my husband kon begin dey avoid my mama. Na me dey use my hand carry...