Her Family Is Cursed 1 By Angela Nwosu
This story was told by a woman it happened to. I got her permission to write it on Facebook. Everything I will write in this story is 💯 % reality. The only difference is that I will tell it as a story and use different names for the people involved. ******************** Her family is a shame! My name na Precious, I be 33 years old. My husband name na Chima, he be 40 years. We don marry for 7 years, na this year go make am 8. We get 3 children, 2 girls and 1 boy. Me and my husband dey get the usual husband and wife wahala, but im no dey beat me or make me suspect am. I dey work for bank, while im get im own business and im dey do very well, money dey yakpa. Na me be first born, I get two brothers and one sister, dem dey live with my mama, my papa don die since 5 years now. After I born my last pikin, my mama get serious problem with my husband when she come omugwo, for my last pikin, over money matter. Since then, my husband kon begin dey avoid my mama. Na me dey use my hand carry...